Friday 25 March 2016

You Guys Need To Read This Alibaba's Crucifix Joke


If Na some Naija carpenters build that crucifix...#goodMonday for be #goodfriday They will sha have an excuse... "Shebi they have sentenced him? What's the hurry?"
"Abeg abeg... If I hear? If una need cross since Na two days to crucifixion Na hin una go come dey pressure me? Why una no book am the day wey una sort Judas? Abeg ooo" "We are on strike.
The Jesus is a son of our member. We no go gree" "I told you to pay since you dey delay.
The wood don dear, because of exchange rates" "You that is asking for express, you get light? Abi Na teeth we go take sampaper am? Abi you no see fuel queue?" "No be small thing ooooo! VIO seized the truck with the nails.
They said there is no C-Caution." "Its first come first serve ooo! We still dey build Dasuki and Oliseh Metuh own.
The other wood wey you dey see so Na for all them service thiefs, sorry, Chiefs... By the way, where is the balance of all the other cross we have done? Shebi una say until they sign budget... Una allowance did not wait till dey signed budget ooo! In fact... The cross will be ready on May Day...

No comments:

Post a Comment